Prince Harry And Meghan Markle Don Officially Marry Today.

Hollywood ogbonge Populajingo superstar Meghan Markle, don officially marry Prince Harry of Great Britain for ogbonge wedding ceremony wey the Archbishop of Canterbury na im join dem togeda.


Tori by Ellen Manning for Yahoo News UK, yarn say the 36-year-old bride wear white gown wey dey design by Clare Waight Keller for Givenchy, with korrect tiara wey dey sparkle.

The couples dem hold hands and kon exchange tear-tear and smile-smile for the ceremony.
Tori yarn say Harry dey emotional when im see im bride for the first time for her simple, beautiful pure white dress and im kon grab her hand and tell her say: ‘You look amazing – I missed you’.

Plenty plenty powerful people and celebs dem too join and attend to support dem.

People like the Clooneys dem , the Beckhams dem, Idris Elba, Elton John, Oprah Winfrey,Serena Williams and im husband Alexis Ohanian, Britain’s royals dem: the Queen and Prince Philip
See the photos:

Leave a Reply