See How Area Boiz For Agege Beat Naija Artist, Small Doctor

For Agege area of Lagos, some boiz for there sama on one of Naija Ogbonge artiste, Small Doctor.

Tori yarn say, Small Doctor go Agege stadium go perform for one event,  wey WinnersGoldenbet dem organize, say na there dem beat am o!

The tori even yarn say, na one person wey call himself fan, no make Small Doctor enter im moto, unless him drop sumtin for them.

So as Small Doctor No gree give dem money na so dem give am beating of im life, evn security men dem wey dey duty that day no fit helep the bobo.
Na until Small Doctor, give dem sumtin, dey com leave am make him dey go.

Leave a Reply