Tori don yarn say Naija music star, Tiwa with im husband, Tee Billz don fail to settle their marriage kata-kata, so therefore dem go get official divorce and dem go scatter afetr 4 years wey dem don dey togeda as husband and wife.
This their marriage kata-kata start after Teebillz bi wan commit suicide after im disgrace im wife for social media.
Na amebo for Inside reveal say Teebillz don quietly relocated go obodo oyinbo America and im leave im son, Jamil for Tiwa, say dem don dey process the divorce, but dem never know wen it go through.