Rat Don Cause Sacter-Scater For Oga Presido Buhari Office, Na Why Im Dey Work From House-Shehu Garaba

Garba Shehu, wey bi Senior Special Assistant, SSA for Media mata to oga presido Muhammadu Buhari don yarn tori people say rats dem don cause scater-scater for the Presidential office and dis na why im dey work from house.

Make una read wetin im yarn

“After im no dey for office for about three months, rodents don cause plenty scater-scater for the furniture and air conditioning units wey dey for im office and dis na why e dey do im work from house,”.

Im yarn say but dem don dey clean and renovate the office.

But im no tell us when dem go finish the renovation wey go make oga Buhari go begin dey go office

Leave a Reply