Resign Now Or You Go Face Impeachment- Kogi APC Leaders Dem Don Yarn Yahaya Bello

The Federal lawmakers, state chairman and other top- top members of the All Progressives Congress for Kogi State don tell the Governor of the state , Yahaya Bello make im resign sharply untop im double registration for the ongoing Continuous Voters Registration.

Yesterday, INEC release  statement wey accuse the state governor say im dey perform illegal act as im register two times for a voters card.

Dem yarn say Yahaya don first register for January 30th 2011 for Wuse, Abuja and com do another registration for the second time on Tuesday May 23rd 2017 for the government House, Lokoja.

Leave a Reply