20 Year Old Girl Don Burn Her Boyfriend House Untop Say Im Cheat On Her

 

One 20 year old Ghanaian girl Priscilla Berfi don turn her boyfriend to homeless person after she don put fire and burn the house for Deduako for the Oforikrom Constituency of the Ashanti Region untop say im dey cheat on her.

 

Tori for Pulse Ghana don yarn say nobody die but the fire destroy plenty-plenty properties dem.

 

As the bobo(boifrind) dey yarn has the tori take happen , Kofi Adusei yarn say:

Im stop to dey take care of Priscilla, wey don get belle because she get bad attitude and  no get respect for him.

 

Im say Priscilla visit am the night wey the matta happen say dem come get misunderstanding so im no come sleep with her that night for the same room ,say im come leave the room and go sleep for another where im put im second girlfriend wey dey wait for am.

As dem come dey relax for the other room, Im come dey smell smoke but im bi tink say na im clothe Priscilla carry go burn so im no come bother. But later, im come hear as people dey shout and call am say im room dey burn, naso im rush out and come see say the room don burn and Priscilla don run.

 

But Police dem don leta  catch am

Leave a Reply