I Bi Hope For Ekiti State – Segun Agbalajobi

For long time Imo River, na wrong people and coconut head Governors dem dey rule Ekiti State, but the time for Change don come and na correct Change i dey yarn una.

No State for this Naija, wey fit jambodi with Ekiti state for education as dem sabi book well-well.

Segun com yarn say im plan na for oda state wey dey Naija to do copy-copy for education mata with Ekiti, as, what im want bi say, if Ekiti dey front front, oda state go dey follow dem for back.
Im say Education System for Naija must improve and carry weight as Knowledge bi power.
Una go ask Why Segun Agbalajobi wan become Governor?
Hmmm! Some bad belle people go say wan do am for money, some go say im wan do am for the power and influence wey dey attach to the job.  But my people, Na Lie!!! Segun no bi poor man wey just wan become richman, and im no jus bi rich man wey dey find  power / influence,  im bi simple and ordinary Naija man wey no dey different from oda people wey dey Ekiti State.

Segun Agbalajobi just bi correct man wey dey stand up for Ekiti and wan add change to it.

Una know say one man no fit change Ekiti state, na why im dey say make una stand up, join hand to support am to make life better for Ekiti State.
ATIJO-OGUN GBERA IYAYA OSOGUN YAGA
– This na im family nickname wey nean say im bi una fighting corner.

Leave a Reply