Dasuki No Gree Go Im Papa Burial

Before-before national security adviser (NSA) Sambo Dasuki wey dey cell for more dan a year,don reject the offer wey federal government give am to go do im papa burial.


Na Minister of Interior, Abdulrahman Dambazaum yarn dis tori for Sokoto today after dem don do Dasuki papa burial, the 18th sultan, wey die on Monday night.

Im yarn say federal government first tell Dasuki say make im go visit im papa wen im sick for hospital but Dasuki no gree as im say im like as in dey the cell,  so im go dey do prayer for im papa for there.

Dem come tell again on Monday night, ssy make dem carry am go Sokoto to do im papa burial, say Dasuki no com gree.

Leave a Reply