We No Dey Give Job O! Na Scammers Dem-NSCDC

Mr. Shuaibu Jibrin,wey bi commandant of Naija Security and Civil Defence Corps for Benue State (NSCDC) ,don warn una Naija people today,

most especially those who dey desperate to get job say, scammers dem don plenty well-well as na dem dey collect money from people wey dey find job.
Say dem dey tell job seekers dem say dem go helep dem get job for inside NSCDC.

Him yarn say job no dey for NSCDC, say if job chance dey,  dem for don do advertisement for radio, television and newspapers dem.

Im com yarn say dem dey put nose down and shine there tourch light eye to find the people wey dey do the scam, as dem dom already catch 3people.

Leave a Reply