Kai Love Na Wicked Thing O! One Chinese Man Collect Disgrace From Im Lover Untop Say Im Propose

Nawa oh!  Make una hear this tori!
One man for China do public proposal for im best friend, wey her name bi Mumu.

Tori yarn say the bobo use 999 number of pomelos fruit wey bi the fruit wey the girl like gaan to do heart shape design for ground.

Im com do small show and a give her bunch of flowers as im dey sing for her say
“She is my idol. She likes eating pomelos, so I’ve bought a lot of them for my proposal.”

But the mata turn upside-down as the girl reject am and yarn say she no love am say she bin dey see the bobo as her best friend but say make the bobo thank you say im bring the fruit because she go carry  am.
She even come tell people wey dey waka pass say make dem pick out of the fruit if them want

Lmao!!!

Love na strong thing o

Leave a Reply