No Marry A Girl Wey No Fit Pray For One Hour Or Wey No Sabi Cook-Pastor E. A Adeboye

Pastor E.A Adeboye wey bi the General Overseer of the Redeemed Christian Church of God, don yarn as im dey counsel youth for church say make dem no marry any girl wey no fit pray for one hour or wey no sabi cook.


Im say,
“make una no marry a girl  because she sabi sing! Say among chior people dem, some people dey wey fit sing well well but dem bi fallen angels!

Make una marry  prayer warrior! Say If a girl no fit pray for one hour, make una no marry her.

Make una no marry a girl wey dey lazy or a girl wey no sabi cook, im say make the girl know how to do plenty house work

Im continue say, make una no marry a girl wey dey worldly! Say if una marry, u don carry wetin you go worship for the rest of your life!”

Leave a Reply