OGA MINISTA OF SPORTS DON FINALLY BEG DREAM TEAM AND NAIJA PEOPLE

Solomon Dalung wey be Naija Oga patapata for Sports don open him mouth take apologize to Dream Team VI say he no try at all for the kangaroo preparation wey make the boys enter Brazil for dem Olympic first match very late.

Dalung beg Samson Siasia men say im shock say dem still win the first match against Japan by 5 goals to 4.

Dalung come promise say every match bonus and training allowance wey don block since,  go show face.
Ademola Olajire wey be the talk talk man for NFF come yarn say Dalung sef still beg Naija people say no perfect human being dey, say make people for obodo naija forgive am.
As e be now, the Dream Team don already qualify for quarter final after dem flog Sweden for Sunday match by a lone goal but as e be, Team Naija go still play Columbia for Wednesday wey be the last match for the group.

Leave a Reply