EFCC Don Arrest Popular Jingo Blogger, Abubakar Sidiq Usman

EFCC don arrest one popular jingo Blogger,  Abubakar Sidiq Usman,wey dem sabi am as Abusidiqu, and also bi the publisher of abusidiqu.com.

Dem arrest am for im house for Kubwa Abuja, Monday August 8th untop one tori wey im carry against the Chairman of the EFCC, Ibrahim Magu, Aug 2.

The EFCC talk talk man, Mr. Wilson Uwujaren, yarn say dem arrest the blogger say im dey do cyber stalking say and the cyber stalking mean say im dey repeat the use of electronic communications to dey harass or fear fear person as im dey send  emails or carry fake tori  online wey fit give person heart attack.

 

Leave a Reply