Make Una Dey Careful! Kidnapper People Dem, Don Dey Use Job Interview Lie To Dey Kidnap People

My people if you get ear,  make una hear well o!
I no say country hard and all of una dey desperate to get job but this na warning make una dey very careful as kidnapper people dem don get new sense.

Dem don find new style to dey carry people and this dem new style no go give dem stress at all – at all.

Tori yarn say, dem go send text messages to ask person make dem come for job interview, wen the person com reach there, dem no go come  let the person go house again and dem go start to dey call the family of the person dem kidnap say make dem drop plenty money.

The tori  come yarn again say, this thing don happen to one person wey dem don kidnap, as im see text message for interview, im com go but dem never let the guy comot,  as dem bi dey ask d guy family to pay N5m.

I don dey talk to much.
The koko bi say, make una no go any interview invitation wey dem send as sms if  una no apply for am.

Leave a Reply