Ghana President Dey Blame Naija For The Light Wey Dem No Dey Get.

The oga Presido for Ghana, John Mahama, dey blame Naija for the light wey im country no dey get.

 Im say Naija dey take time to dey deliver crude oil for dem and dem no fit power thermal plants for Ghana, because of the Niger Delta Avengers, wey dey cause Kata-Kata and dey blow up oil and gas pipelines for Niger Delta.

But him come assure Ghanaian people dem,  make dem chilex as everything go so become normal very soon.

Leave a Reply