Oga Sound Sultan, Abeg Buy Shoe For Your House Girl Na- Fans

Fans! Fans!! Fans!!! How many time i call una?
Lol!  Nawa for una ooooo!

As the Ogbonge popular jingo musician wey also bi producer Sound Sultan ,dey jolificate Eid Mubarak,im com share us fine photo for Instagram of im family as dem prepare for the merriment.

Naso the torch light eyes of fans dem  just see say one person for the photo dey wear slippers, dem com conclude say the girl na house girl and begin dey yab sound Sultan say see as all of them fine for the photo, na only the girl no fine, say Eid Mubarak na for kindness but im no show kindness, say dem dey disappointed as e sure say the girl dey suffer for im house,  make dem buy the girl shoe.
Somebody even yarn am make im tell im wife make she go learn from @tontolet -Tonto Dike.

Nawa o! See comentry

Leave a Reply