Facebook Don Block One Sisi Because Say Her Name Bi ISIS

Facebook don block one 27 year old sisi, Isis Thomas, wey come from obodo oyinbo Bristol,UK because say, her first name bi ISIS.


Isis Yarn say on monday, she bi wan enter into her profile, naso she see say Facebook dey ask am to change her name wey she take open.
She com yarn say she bi think say na her
Second name Isis “Worcester”  dem say mk she change, she com change am to Isis “Thomas” ,  but the thing stil dey ask make she change her name, she com see say na the Isis Facebook dem dey talk about, because dem send her message say the name no follow Facebook policy.

Leave a Reply