We Go Soon Go After Bank Managing Directors – EFCC Chairman

Hmmmm! This na fire for fire oh, as Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don expose to us their next target.

Ibrahim Magu, wey bi the Chairman for Economic and Financial Crimes Commission, don yarn say dem dey go after anybody wey do 419,say im no wan know weda na blackie or oyinbo, or weda the person come from party A or B,  but im own bi say, im ready to arrest anybody wey the hand no clean.

Him say all does banks dem wey dey do private banking na dem dey allow politicians to dey loot money, say im don take the mata go meet the oga Governor for Central Bank so the loot-loot mata fo fit stop

Im come say very soon dem(EFCC) go, go after the Managing Directors of the banks.

Leave a Reply