US Don Use Force Carry 41 Naija People Comot Their Country

United States government dem, don say alele, abeg carry your load comot to 41 Naija people.

Dem land today for Murtala Mohammed International Airport wey dey Lagos around 12pm and na Miami Air International charter plane carry dem come.

Tori yarn say some of the people dem send comot for US, dey carry drug for there and some get Kata-Kata with police and immigration people dem.

Leave a Reply