Sokoto Governor Don Increases Allawee Of Corp Members Wey Dey Serve For The State

Sokoto state government don add money join the allawee of Youth Corps members wey dey serve for the state.

The, Governor Aminu Tambuwal yarn dis new tori for batch A Stream II corps swearing-in ceremony.

Him yarn say:
“Graduates of medicine wey dey collect N36,000 before,go dey collect N50,000, Pharmacists wey dey collect N19,000 before go dey collect N25,000, graduates of lab science and other medical people like nurses,wey dey collect N9,000 before, go dey collect monthly stipend of N15,000.

Im continue to yarn say, graduates of social science and humanities, go dey collect N5,000 as im don help dem put one thousand naira Untop the N4,000 wey dem dey collect for state allawee”.

Leave a Reply