Prophet For South Africa, Put One Woman For Im Church Inside Deep Freezer For 30 Minutes

Nawa ooooo,  na everytime this South African Prophet, Penuel, dey do strange strange things.
I no no wetin South African government dem dey sidon dey look o, until im don kill plenty people before una go wake up abi?

Hmm! Naso this man, yarn one sisi for the church to enter inside a deep freezer wey dey Freeze well well and tell the sisi make she sleep, the prophet come close the Freezer for thirty minutes.

After wey Thirty minutes don reach, im come go open the freezer and tell the sisi make she wake up, im com ask her say wetin happen for inside there.
The sisi com reply say, instead make she feel cold,  say na hot she dey feel, say she no feel any ice wey dey for the deep freezer at all-at all.

Abeg na normal thing bi this? If he wan show say im get miracle skills, why im no com Naija come feed all Naija people with 5 loaves of bread and 2fishes as Jesus For Bible do.

Leave a Reply