Fire Burn Woman As She Dey Use Her Phone For Petrol Station.

For petrol stations, dem don dey put many many signs to dey warn customers make dem stop dey use their phone for there, especially wen dem dey fill up petrol, as e fit cause make fire spark, but people no dey hear word.

For one petrol station, for Setapak Indah, Kualar Lumpur,for Malaysia yesterday, June 28, one woman carry 60% burn injury for her body when flames cover her as she dey  fill her car with petrol and use her phone at the same time.
How e take happen bi say, sparkle come out from the fuel pump and go trigger reaction with her phone which com cause fire.

Science students, una go understand wetin i mean.lol!!!

Leave a Reply