Federal High Court Don Send Abia State Governor, Comot From Im Office

Justice Okon Abang for Federal High Court wey dey Abuja don say “alele” make Governor of Abia State, Okezie Ikpeazu,park im load and comot im office quick – quick.

Reason bi say, court see say im dey guilty as im submit fake tax clearance document to the PDP wen dem wan do party governorship primary for December 2014.

Tori yarn say na Ikpeazu rival, Uche Ogah, go write petition to court and come give dem evidence of all the fake- fake tax clearance wey Ikpeazu submit.

Leave a Reply