Toyin Aimakhu, Adunni Ade Dey Rake Eachother Untop Baby Mama Matta

Two of  Naija entertainment ladies Toyin Aimakhu, Adunni Ade dey rake for eachoda untop music singers wey dey give entertainment industry bad name as dem dey go for baby mama instead make dem marry put the wife for house.


Toyin Aimakhu yarn say she blame women wey dey open their legs for men just like dat and carry belle wen the man never put ring for their hand.

Adunni Ade come change am for Toyin.  She say make Toyin no go there at all – at all, say to bi baby mama na matta of choice.
She yarn Toyin make she no poke nose for another person matta, say her own dey her bodi.

She continue to yarn say,  baby mama dem kuku beta pass dose who dey for marriage wey dey suffer like monkey wey dey look for Banana.

Leave a Reply