Tomato Paste Wey Dey Cause Cancer Don Full Berekete For Market

Who say our honorable wey dey for House of Representative no dey work?
Hon. Nicholas Ossai(PDP Delta State)  don prove una wrong.


He don cry out say make everybodi for Naija  dey very careful  say some coconut head people don bring tomato paste wey dey cause cancer from obodo Oyinbo come dump dem for Naija,  make Naija people chop am and kpemee.
He yarn say some peole wey dem call demself Cabal na dem dey behind dis cancer tomato paste.
He com dey warn Naija people especially people wey no get shingbain say if una see cheap tomato paste, make una pick race ooo!  As e bi say cheap thing na him dey kill person.

Leave a Reply