Jennifer Lopez Don Buy Ogbonge Mansion For Los Angeles

Jennifer Lopez don put hand for pocket buy  new house.
Dem yarn say the house na one of best house wey dey for Los Angeles. 

Tori yarn say, the owner of the house Sela Ward  bi wan sell the house for $40 million, but Lopez price am sote she come  buy am $28 million.

Hmmm!  and if una see the house, my people you go fear fear as the house big no be small and e fine well well.
The main house bi  13,000 square feet, and e get im own lake and a beach.

Leave a Reply