Gbege Don Happen: Former PDP Chairman Don Yeye Fayose And Mimiko

War of mouth don shele for PDP as former Osun State Chairman Ola-Oluwa mess up Ekiti State Governor, Ayodele Fayose and im mate wey bi Ondo State Governor, Olusegun Mimiko.


Ola-Oluwa yarn say the two Governor don chop fowl leg, say dem too dey make yanga and dem dey call demself PDP southwest leaders.
E say make una no mind dem o, say the immunity cloth wey dem wear go soon tear pere pere for their body.
Say the two of them bi selfish oporoko leaders.

Leave a Reply