Buhari Dey Come Lagos: Make Una No Cause Kata-Kata For Road Till E Comot- Lagos Commissioner

Lagos State Commissioner for informate, oga Steve Ayorinde don yarn say, Naija oga patapata, oga at the top,  Muhammadu Buhari go land gbamu for Lagos on Monday, May 23 2016.


He say,  dis na Buhari first official visit to Lagos as he wan come put eye for all the work wey Oga for Lagos State, Ambode don do for the one year wey him don enta as Governor.

The Commissioner come dey warn all jaguda boiz and everybody make dem no cause kata kata for road till Buhari comot.
He say make everybodi stay kule.

Leave a Reply