Kushemi-Moses Family Of Ikeja Don Give Warning To Those Wey Dey Install Strangers As OLU OF IKEJA To Becareful

The family of Kushemi-Moses of Ikeja wey the man wey tanda as chairman, ogbeni leke Moses don give strong warning for those wey dey parabulate demself as Oba for Ikeja kingdom to be careful.


He yan say all did nonsense wey dem do go cos katakata and kasala becos Ikeja na town wey dey peaceful.

All de pepple wey call demself royal family wey pick strange person, must not turn Obaship matta to politics, Oba position na tradition and no be for politician.

Him con say if things no dey normal na for court dem go, go settle am.

He say make him remind dem, people wey first settle for Ikeja na Oshoja, Amori, Iyade-ilo, Kushemi and Balogun royal family. Even though dis forefathers don’t kick bucket but their pikin still dey on ground.

Make dem go check history, say na Kushemi bring Christianity to Ikeja and im name dey First Baptist Church record till today.

So, himĀ  call the Lagos State Gov Ogbeni Babajide Sanwo-Olu make him intervene for the matta befor kasala burst.

Leave a Reply