Regina Daniels’ Husband, Ned Nwoko Don Engage To Seventh Wife

Tori don dey waka about say Ned Nwoko, wey bi the  billionaire husband of Nollywood actress, Regina Daniels don set to take 7th wife.

The lady wey dem don identity as “Sara” and “Sar8al” on Instagram bin dey Naija for some time, and Regina Daniels dey share her photos and videos both Instagram and Snapchat including the one wey she flaunt her engagement ring with the caption “wifey”.

Ned wife

Dem spot Sara with Regina Daniels in Abuja over the weekend, as dem dey chill for the pool wey dey Ned Nwoko house and also she dey cruise the cars wey Regina Daniels don use.

But she don now-deleted videos wey she (Sara) share on her Instastory.

She also share photos wey she snap for Ned Nwoko house with the geolocation “secret location“.

wife

Insiders don yarn say she go also do the traditional marriage rites just like Regina Daniels, as Ned Nwoko  “believe in culture”.

wife

Regina Daniels and Ned Nwoko  marry in 2019.

Leave a Reply