FG Dem Don Announce Say Dem Go Close 3rd Mainland Bridge For Six Months 

The Federal Ministry of Works don yarn say dem go close 3rd mainland bridge wey dey for  Lagos for period of six months starting  from July 24.

The Federal Controller of Works for Lagos, Olukayode Popoola, say dem dey do consultations  for another phase of repair works to begin on the 11.8 km bridge.

Popoola yarn say the repair works go start on the outward mainland section of the bridge.

Im yarn say the Ministry dey work already  with relevant agencies dem ensure say  traffic no dey for this period.

 

Leave a Reply