Dolapo Badmus Don Yarn Say She No Talk Say Men Fit Sue Women Wey Refuse To Come Their House After Dem Send Transport Fare

Zone 2 Police Public Relations Officer, Dolapo Badmus don deny tori of her say men fit sue women wey refuse to come to their house after sending transport fare.

The tori yarn say lawsuit dey to back Act 29:Section 132 of the criminal code and fit attract a 5 year imprisonment sentence.


But for instagram post, Dolapo Badmus yarn say na “false statement”.

Make Una read wetin im yarn ;


Disclaimer!!! MY ATTENTION HAS BEEN DRAWN TO THIS FALSE STATEMENT CIRCULATING PURPORTEDLY FROM ME! I DID NOT AT ANY POINT MAKE THIS STATEMENT AND IN MY USUAL CHARACTER IF I HAVE MADE IT I WILL STAND BY IT BUT NEVER AT ANY POINT HAVE I MADE SUCH! I HEREBY DISASSOCIATE MYSELF FROM IT! THANK YOU.

Leave a Reply