Make Una No Look For Miracle In 2020, Look For Jesus- Pastor Odejobi Don Advise Naija People

The Zonal Superintendent of Christ Apostolic Church, CAC, for Transfiguration Zone, Pastor Emmanuel O. Odejobi don advise Naija People say make dem no look for miracles this year, but make dem look for  Jesus Christ, wey bi the miracle worker.

Pastor Odejobi yarn this for his New Year Message for the crossover night of Transfiguration Zone wey dem do for Ifako Mini Stadium, Lagos.

Make Una read wetin im yarn

“Fear the Lord this year. Don’t sing it as songs alone. Blessed are those who fear God. The fear of God will not allow you to do your will, but His will. Children of God who acknowledge God’s goodness will always fear Him. There is no lack to those who fear Him. The fear of the Lord is to hate evil,”
He also give advice say make dem dey careful about the church they attend say that difference no dey between some church dem and herbalist house, and between some ministers of God and herbalists.
Im also advise Naija People say make dem dey careful of love of money, say na love of money put Naija for the present situation.

Leave a Reply