Brazillian Gang Leader Try Escape From Prison As Im Dress Up Like His Teenage Daughter

Dem Don Catch one 42-year-old Brazillian prisoner wey wan try escape from prison as im dress up like his teenage daughter.

Clauvino da Silva, wey bi gang leader wey dey serve a 73-year sentence for Brazil prison untop drug trafficking.

Im 19-year-old daughter  visit am and im try pull jail-break as im diguise as his daughter. But prison officials dem notice as im dey he look and  dey behave so dem kon stop am.

Officials kon release photos of Clauvino da Silva, wey dem sabi am as Baixinho, or “Shorty”, as im dey wear silicone mask, long wig, glasses, jeans and pink girl T-shirt.

Leave a Reply