14 Years Old Girl Don Commit Suicide For Delta Untop Boyfriend

Nawa ooo!!! Pikins dem of nowadays enh…

Tori don yarn say one 14-year-old Senior Secondary School student of Kess College for Ekredjebor area of Ughelli, Ughelli North Local Government Area of Delta State, don commit suicide untop failed relationship with her boyfriend.

Tori from Vanguard, yarn say dem find the body of the girl wey her name bi Favour wey dey for SS1, for ceiling fan for her house as she hang hersef with suicide note as she write the reason why she hang hersef.

Favour na the only pikin of her parents and she dey house alone when she do wetin she do.

Make una read wetin one of the neighbors yarn

“It was one of the girl’s friends that raised an alarm when she saw her body dangling from a ceiling fan. When people came into the house, they also saw a note she had written, stating that she decided to take her life owing to a failed relationship with a male from the same school she attended.”

Police dem for Ughelli ‘B’ Division Police Station too don confirmed the tori and dem don start to dey do investigation on the matter . But say dem don deposit her body for morgue.

Leave a Reply