COZA: Make Una No Let Religion Scam You, Make Una Shine Una Eyes- 2face 

Naija music legend, 2face Idibia don warn Naija People wey dey practise ‘religion’ and no dey shine their eye.

This na after Naija Pastor Biodun Fatoyinbo of Commonwealth of Zion Assembly, dey trend for inside news.

2face, yarn dis for im Twitter page

Make Una read wetin im yarn

“Any god wey say make you judge another person na scam. Any person wey say God tell am to tell you anything na scam.
“Any god wey say make you kill person for am na scam. Any god wey say make you give another man money for am to bless you na scam
“Any god wey say make you judge another person na scam. Any person wey say God tell am to tell you anything na scam
“#ONELOVERELIGION but open your eyes.”

Leave a Reply