Bill Gates Don Fall From ‘Second Richest Man’ Position, As Im Lose To LVMH’s Bernard Arnault

Microsoft founder, Bill Gates no bi the second richest man in the world again as im lose the position to Bernard Arnault wey bi the CEO of LVMH.

News Agency of Nigeria (NAN) don report for the latest ranking by Bloomberg’s Billionaires Index, say Arnault dey for second place as Jeff Bezos still dey first place.

Arnault and im family dem bi the  majority owners of Christian Dior and LVMH, parent of such brands as Louis Vuitton, Celine, Fendi, Moët, Hennessy, Dom Pérignon, and others.

Tori from Bloomberg yarn say Arnault share for 2019, don reach over $107.6 billion, wey bi more than $200 million ahead of Gates share.

Dem yarn say Bill Gates suppose don get rank as the richest person, even pass Bezos if no bi say im bi philanthropist and dey all ways do giveaways wey give chance for Arnault.

Leave a Reply