To Bi Father No Bi Beans ooo- Tonto Dikeh Don Yarn

Sunday June 16th na fathers day and to Jolificate it, Tonto Dikeh son, King Andre school don organise novelty match for fathers of students dem wey dey their school.

Tonto wey dey stand for her pikin as the father as she go play for the Novelty match share dis tori for her Instagram  page, as she call herself  ”MammaD Papa”.

Make Una read wetin im yarn
”To be a father isnt beans ooo!!!
BUT what a man can do KINGTONTO CAN DO A 100TIMES BETTER!!
#ShoutouttoSUPERFALCONS#MAMAD ‘PAPA

Leave a Reply