Ahmed Lawan Don Become Senate President

Senator Ahmed Lawan wey dey represent Yobe North Constituency win as the Senate President of the 9th Senate.

Na im colleagues dem elect am.

Ahmed Lawan use 79 votes to defeat his opponent, Ali Ndume wey dey represent Borno South as im get 28 votes.

Make i give una Profile of Lawan:
Ahmed Ibrahim Lawan na Naija senator wey represent the All Progressive Congress for  Yobe North Constituency of Yobe State.

Im became senator in 2007.
Im receive  bachelor’s degree in geography from the University of Maiduguri, master’s degree in Remote Sensing from Ahmadu Bello University and  doctorate degree in Remote Sensing/GIS from Cranfield University, UK.

Leave a Reply