Khloe Kardashian Don Reveal Say Time Don Reach For Her To Leave Basketball Players Dem

Reality star, Khloe Kardashian, don yarn say  she go stop to dey date basketball players dem for accountants after the recent cheating scandal wey happen between her ex- Tristan Thompson and Kylie Jenner ‘s best friend, Jordyn Woods.

She yarn dis tori for joint interview with her sisters Kim and Kourtney Kardashian for Jimmy Kimmel Live, the 34-year-old reality star yarn say her grandmother MJ,  wey bi 84 years old , joke with her say make she  try ‘date accountants’ instead.

Make Una read wetin im yarn

“I like what I like. What can I say?”

I just like to observe basketball games. It’s the whole thing of it all. But I do agree, I should probably listen to my MJ, my grandmother, I should probably start to date accountants or something like that.”

Leave a Reply