Babajide Olusola Sanwo-Olu don win the Lagos guber vote.
Im beat Jimi Agbaje wey bi candidate of the Peoples Democratic Party and other people wey dey battle for the post.
For the official result wey INEC release, Babajide Sanwo-Olu get total of 739,445 vote as im beat Jimi Agbaje wey get 206,141 vote.
This na the third time Jimi Agbaje go lose the Lagos guber elections as im don lost to the last two governors dem for the office.