Madamaproko MAN OF THE DAY

Good morning my people!!!

Our MAN Of The Day Na “Timi Dakolo
Reason Bi Say, Today Na Him Birthday

Make i yarn una little tori about am

Timi Dakolo wey dem (born; January 20, 1981) for Accra , Ghana by im papa wey bi from Naija, Bayelsa State and im mama wey bi Ghanaian.

Timi na korrect Ogbonge popular jingo Naija singer wey start im singing for church wen im dey twelve years of age.
2003 him join one singing group “Purple Love” as founding member.

Im bi the winner of the Idols West Africa for 2007,after im victory, he kon get recording contract with Sony BMG, with other water mouth prizes .
Now im dey signed with Lone Records/Now Muzik.

Timi Dakolo na one of the Judges on The Voice Nigeria.

Timi Dakolo na married man, and na im sweetheart, Busola Dakolo im marry in 2010.
God kon bless dem three children.

This na some of the song wey im don sing

2011: “There’s a Cry”
2014: “Iyawo Mi”
2015: “Wish Me Well”
2016: “The Vow”
2017: Medicine
2018: I Never Know Say

Happy BIRTHDAY TO You bros🖐️
May God Grant You Every good things wey your heart desire.

Leave a Reply