EFCC NO RAID ATIKU’S PIKIN HOUSE, NA THEODORE’S PIKIN HOUSE WE GO.

Kaai na big lie say we raid PDP future presido pikin house.


Na Senator, befor befor Gov. Theodore Orji we dey investigate for moni laundry mata we pok nose. As we dey put eye so we com discover say na true im pikin he take launder d moni.
We hear say im pikin Ogbonna Orji, 32 dey drive one ogbonge Range Rover wey im buy for N100 million and im friend Kelvin Ilonah too buy anoda Range Rover for N35 million and both of dem rent a house for N35 million. So na lie of d highest orda say we EFCC poke nose for Atiku mata.
Na d news carrier, talk say we block PDP Vice president Peter Obi account for im bank, all na just political campaign for pepple to sympathy we with dem.

Leave a Reply