E-Money Don Gift Comedian, Funnybone Tear Rubber Mercedez Benz E-Class For Christmas 

 

E never reach 48 hours wey Naija Billionaire business man E-money buy imsef Rolls Royce im don bless one Naija  comedian, Funnybone with Mercedez Benz E-Class for Christmas.

Naija  comedian wey bi On Air Personality, Yaw take im page to share the video of  Funnybone as im dey receive im gift.

Make Una read wetin im yarn

@iam_emoney1 blessed @funnyboneofficial with this E Class, God bless this man for us. He has been a blessing to me now and always.

Congrats bro…

Leave a Reply