Environmental Palava for Peace Community, Oruku, Oko-filling Ijagba.

D pepple of Peace Community Oruku for Ijagba, Oko-filling in Ogun State say dear life dey for danger make d State and d Federal Gofament of Naija come deliver dem, becos erosion go soon wipe d community away.

Dem say d Omo nile wey dem dey call ‘Land Grabber’ don bring one Alhaji Bisiriyu come dey pack Sand-sand from d Oruku water and dis go cause problem as d water go soon overflow d area. For about 4month now cata-cata don dey show face between d pepple of d community, d Ojomo, Ijagba family and Alhaji Bisiriyu ova dis matta. Dis Alhaji Bisiriyu business b say im dey waka dey damage everywhere to carry sand go dey sell.

D pepple of Peace Community Oruku for Ijagba b peaceful pepple, so dem dey say enough of dis Omo nile wahala. Dis kind tin don show face befor wen d Omo nile destroy part of d community to carry Sand filling. Till today everiwhere don spoil. So dem dey appeal to Gpfament and pepple of obodo Naija to stop dis Alhaji and Omo nile.

Leave a Reply