Prophet Faleyimu Don Predict Say 5 Naija Actors Go Die Dis Year, And Two Don Already Happen

God no go let aproko ki mi ooo
But my people dis tori wey i wan talk about enh!!!

Una remember say one Prophet Faleyimu Olagoroye wey bi the founder of Mountain of Blessing and Miracle Church of Christ, don predict early this year say 5 actors dem go die dis year 2018.

And im advise dat tym say make dem Nollywood celebs dem dey prayerful so dem fit escape the untimely death

Make una read wetin im yarn
“The Nollywood industry should be prayerful, so that they won’t lose 5 stars among them this year. Saheed Osupa, Obesere and Pasuma should also engage in serious prayers against hardship this year. God is showing me that hard time will force them to be selling their properties.

“A lot of Actors will face hardship especially the women among them. Rich men will deceive them to leave their marriage and at the end, they go back to square one. Why this will happen is because some of them don’t believe in God, they belong to many secret societies. Those who are for God would not witness the hardship. The identities of the 5 that will die weren’t revealed to me.”

Despite this tori wey im yarn, many people still no believe am, som sef dey call am different names for social media.
The tin wey shock mi bi say the prediction com to pass as two actors don Kakutu remain 3.

Make Their Gentle Souls continue to rest in peace.

Hmmm!!! The question now bi say, who go bi next?

Leave a Reply