I Go Report You To Davido- Fayose aide, Lere Olayinka yarn Dele Momodu

Dis na the gist. 

Dele Momodu share throwback video of some civil servants dem as dem prostrate and kneel for the floor as dem dey beg Governor Ayo Fayose wen im enter the state secretariat and discover say dem dey go late to work.


The Special Assistant to Governor Ayodele Fayose for Ekiti State for Public Communications and New Media, Lere Olayinka, no con gbadun the vedio as state governorship election don dey come, Lere kon post photo of Dele Momodu untop bed and write
”See how @DeleMomodu is messing himself up on Instagram. Just the way this buffon called Dele Momodu campaigned for Calamity Buhari, he is also campaigning for Failure Fayemi. Olofo somebody”


Dele Momodu no like wetin Lere comment he too kon fire back and e turn two fighting wey con cause make Lere threaten say im go report Momodu to ogbonge singer Davido.

Leave a Reply