I Bi Wan Empower My Fans Dem-Toyin Abraham

Naija ogbonge actress wey also bi producer, Toyin Abraham wey una know before-before as Toyin Aimakhu talk say she bi wan empower im fans.

Toyin don say for her recent movie wey she just drop, Alakada reloaded don get 75 million naira., say na the first movie for Naija language wey go sell reach that amount. 

So, she bi wan say thank you to her fans as she talk say she go empower her fans with make up, bead making, cake making, fashion designing and chance to join her to act for her next movie.

Make una read wetin im yarn 

 

 

 

She talk say she go pick between 150 and 200 people for this empowerment programme.

 

She never give details yet but she talk say she go give the details for her instagram page on how person fit quality for am.

Leave a Reply