Cow Don Enter Gobe As Farmer Don Drag Am Go Police Station

One farmer, Elder Samson, don arrest cow untop say the cow dey destroy im crops for im farm.

Tori yarn say this matta happen some days ago for Sabon-Gari, Abaji.

Person wey call im sef eye witnesses, wey dey dre wen the matta happen don yarn say the owner of the cow run leave im cows wen im see say the owner of the farm don dey come,  na there the farmer arrest the cow
”When the herder saw the farmer coming, he escaped and the farmer arrested one of the cows and tied it up, got a pickup van which took the cow to the council secretariat”.

Abaji Divisional Police Officer (DPO), CSP David Kolo don confirm say dem arrest the cow and e dey police station  but dem still dey wait for the owner to come claim say na im get am. Say even court don order say since dem never see anybody to claim say na dem get the cow, make dem sell am and use the money to do compensation for the farmer.

One Response

  1. Temitope

Leave a Reply