Dis Na Hot Tori As Kemi Olunloyo Don End ‘Beef’ With Pastor Adeboye, Linda Ikeji , Olamide And Other People Dem

Popular jingo media personality, wey dey attack everybody for social media and also cause Kata-Kata, Kemi Olunloyo don yarn say she don end the beef wey she get with some particular people for social media.

Madam Kemi yarn dis hot tori for twitter today as she list the names of the people she wan end her quarrel with.

Make una read wetin she post

“Today I officially end my beefs with everyone on #socialmedia. I will be changing #Nigeria to empower others without seeing faults,” she tweeted.

Her list : General Overseer of Redeemed Christian Church Of God, Pastor Adeboye;  blogger, Linda Ikeji; rapper, Olamide; Before-before  president Olusegun Obasanjo; Before-before  Miss Nigeria, Bianca Ojukwu, Sahara Reporters, Naija youth and her papa Omololu Olunloyo.

Leave a Reply